BBC Pidgin: Akufo-Addo Bore sey people dey charge $100,000 make dem seat close to am
Di most expensive seat for di whole world dey Ghana, ei dey cost USD 100,000 to seat near Ghana President Nana Akufo-Addo.
Accusations comot say Trade Ministry dey charge expatriate businessmen between $15,000 - $100,000 make dem get seat near di President.
Deputy Trade Minister Carlos Ahenkorah admit sey some people pay dis kind money to seat next to di President but di money no come Trade Ministry, instead ei go Millennium Excellence Foundation who dey organise demma Millennium Excellence Awards.
President Akufo-Addo dey demand answers President Akufo-Addo bore over di matter as ei direct ein Trade Minister Alan Kyeremanteng make ei explain by close of day how accusations from minority members of parliament emerge say dem collect dis amount without eim knowledge.
Director of Communications at the Flagstaff House, Eugene Arhin come reveal sey Preisdent Akufo-Addo no get any idea say people dey pay chaw money make expatriate businessmen book seat by ein table.
Minority dey call for probe into di matter
National Democratic Congress member of parliament, Samuel Okudzeto Ablakwa, make strong argument say "we be clear for our minds say dis be corruption. Corruption be sey one dey use public office for private gains...which dey mean sey people dey pay between $15,000 - $100,000 make dem get table next to Ghana President event under.
Minority MPs for parliament dey call for probe into dis matter wey dey involve corruption den conflict of interest.
Source: BBC
Disclaimer: Opinions expressed here are those of the writers and do not reflect those of Peacefmonline.com. Peacefmonline.com accepts no responsibility legal or otherwise for their accuracy of content. Please report any inappropriate content to us, and we will evaluate it as a matter of priority. |