Suspected Coronavirus Case For Lagos Test Negative - BBC

Lagos state goment for South West Nigeria don confam say no coronavirus case for di state, afta one Chinese citizen, test negative to di COVID-19 infection.

On Wednesday February 26, 2020, tori bin come out say authorities dey investigate one case from Reddington hospital Ikeja Lagos, afta one Chinese citizen wey just come from China seven weeks ago, present himself for di hospital with symptoms of fever.

Di tori bin put pipo on di alert but authorities bin come out to kill any rumour and say dem dey investigate.

Di state Commissioner for Health Professor Akin Abayomi say, di conclusion and investigation and ogbonge testing dem do, confam say no case of coronavirus for Lagos as of now.