BBC: Nigerians React Afta Singer Davido Raise Ova '40 Million Naira In One Hour'

Davido name na top trend for Nigeria social media space afta di musician share video say make im friends send am money.
Just some minutes afta im share di post, di artist wey im real name na David Adeleke later share one screengrab of im bank account on Twitter wia im say fans don send millions of naira one hour afta im ask dem to.

"If u sabi say I don give una hit song .. send me money," Davido tweet before im start dey share updates of how dem don send am di money dem.
Im also post video wia im tok say "I wan sabi who my friend be, If you know you be my friend , send me 1million Naira.